Thursday 12 January 2012

Wetin Consine Federal Government of Naija ?!

Welcomee My people! This new year God go bless you!
As you de see, i've not blogged for some time .... But sometin don happen wer i no fit hold my mout no longer. Water don break wer be say Goat mama no fit hide her labor! But today my people i must admit from the bottom of my heart that the Government of my Great Nation Naija don VEX MEE BEYOND REPAIR!!

Before i go start my vent, mek una hear this new jam by Tha Suspect.. Very Fela

GOOD LUCK JONATAN! & THE REST OF YOUR GOVERNMENT, NA GOD SEND YOU TO PUNISH NAIJA!?! Yes!!! I said it!! Oya come and beat me if you fit try!  During the elections, for the first time in my life i was very concerned in who shall become the next naija presido... Me ohh!! Me that couldn't care less before about who carry presidency for head but after analyzing the condition of Nigeria i really did pray that the next president would better the land... and with everyone saying that it was about time that a southerner took over government and that PDP were good and Jonatan was the hope naija so desperately needed, me like mumu i now followed the crowd of zombies rooting for him. But i have come to a well thought off decision, Naija Goverment, whether dey b PDP or ANPP or DPP or CPC or any of them, majority of the time if not all the time na money dey wan chop!!!

As the people of naija dey sell akamu for street in order to finish paying off their school fees, these bufalloes jus deh relax as they chop banga soup and amala in their plush homes!! Eh-Ehhnn now!! See wetin my bruda Tha Suspect highlighted to us, How can Jonatan spend   N200 MILLIIIOOONNNN NAIRA A YEAR ON GARDENING?!? NA DA GARDEN OF EDEN!! Jonateliii ohh you wan kill us troway! That N1 Billion that you spend on choppin u go vomitttt am!! My people, i no de yarn ohhh but Yawa Don Gasss!!!  Kai!! Theif!! Ole!! But this no be "Carry and Go!!" moment ohh, YOU MUST BRING AM BACK OR YOU NO GO SLEEP WELL!! When i discuss this topic with my girls and dey go tell me of there brudaz who don collect 1st class for University in Naija but no find job, or when there mumsie or papsie no de well, unless they have money to tek am go hospital for abroad, chances are they go die troway for the hands of Naija Health services, i de shoocckkk!! The matter mek me de feel cooolld as if i don see ghost! But in the same land wer ppl deh pray to God to find simple gari weh de go use chop, they are stinking rich people that sleep each night in  N12 BILLION NAIRA Mansions!!!! POLITICAL JAGUDA! 



Straight Up! I no go hold my tongue any longer! America, United Kingdom, China dey laugh at us, although dey too de chop people's money, der people still de prosper.. atleast small!! But for us, Efiko no find work no longer! Breast milk don finish for pikin to drink! In order to survive, people deh result to ogunje. 
But hey, wetin consine federal goverment! 


They just use empty promises carry commot face, ABEGGG!! Mek i hear word!! Na grammer be dat one ohh!! See GHANA!! WE, US, NAIJA PEOPLE they provide them electricity but WE OURSELVES HAVE NONE!! Nepa has become a Bloody tourist attraction!! Chai! Dey go tell us that this subsidy is going to benefit naija economy.. Mcchheeewww (kmt) .... Na subsidy you wan use cover up decades of corruption? Mchhheeewww, I no blame you, na real craze dey worry you well well !! See how naija people jus de veeexxx, u go think that the whole nation don join confra! And what de painn me pass is the $32 BILLLLIIIIOOONNN no be million oh, BILLLIIIOOONN DOLLARS that has been squandered in Nigeria.. $32 BILLION US DOLLARS UNACCOUNTED FOR!!! WER U HIDE AM PUT FEDERAL GOVERMENT?! UNDER YOUR BED? Ekpami O!! God have mercy!! No jobs for educated people in naija yet a Lady that sounds like she no pass JS1 don carry First Lady Cabinet!! 


“If you carry ya women rish dia, protect ya vote; they have expand Enugu airport to make sure you can flew ya goods to south east, atink my husband & him junior broda have do well. mind you, we women have short time to born shidren, man can born shidren till 100yrs so dont let mans to use ya shidren as militancy or as togs or army robbering, ask ya youths to enter house.” - Dame PATIENCE JONATHAN


Dame Patience aka Mrs "My Fellow Widows" gbagauned constantly. The chik fine small for face but na gbagaun full her mouth. No wonder our people deh shame to tell employees from abroad dat dey are from naija.





O boi, all this wahala de taya me. Gbagae don bust for Naija, no be small ting. If say i kno, i no go vote for GEJ. I for one, is trying to figure out how i could prove a point to this government whilst i'm in Jand... Nonetheless, I have a suggestion sha... just a smallllll suggestion.. If all naija women, in naija and abroad, UK, US, Japan, Yugoslavia, Everywhere, barb de hair, like real time barb de hair Gorimapa and then use cellotape tie their ynash wer be say all women Ikebe de appear flat like pan cake, in addition all women now strike against Rich Men, as in dem old papa Aristos and all them fools that believe that their money and expensive Agbada's na good reason to insert their sim card into young women, If us women remain firm, like kakaraka, these men go suffer ohhh!! The go see Qweehh!! They go beg goverment to end corruption cus corruption deh turn our women kolo! I deh tell u, wen women refuse to open leg for dem, and dey no see big ynash, flowing hair, men go collapse oh! Even GEJ himself go beg una... Anyway Na taught sha, consider am!

And for any corrupt politician dat is reading this blog right now, mek i warn you, you know say Khaki no bi leather, Everyday for the thief ...but my friend... ONE day for the owner.



I don talk finish!!